Nana nana nana nana nana nana nana aaaaaa
BoyMx
Wahala be like bicycle
E no sure for anybody
It can happen to me
It can happen to you
It can happen to anybody
Whether your name na Chukwudi
Or your name e be Dangana
When the problem e start
Problem e finish
Another one continue.
See this iPhone you want to buy
Another man e dash am
See this music you want to do
Another man na legend
See the man you dey hurry to marry
Another girl e dump am
Even house wey you say you wan build my brother another man don build am
What is it just stop to dey worry
Wahala no dey finish
Even if you get the money baje
Wahala no dey finish
See this life e no balance
So wahala no fit finish
If you get you no get
E no mean my brother
Wahala o kin tan
Just dey jaiye dey thank God.
I just want to live my life and go (Cos wahala no dey finish)
If you get you no get
E no mean my brother
Just dey jaiye dey thank God (wahala no dey finish)
Said I just want to live my life and go (wahala no dey finish)
If you get you no get e no mean my brother just dey jaiye dey thank God.
Softly softly as you dey do
No go dey wear another man shoe
He dey wear 32
You dey wear 42
You dey carry him shoe
How you wan take waka?
If dem no ask
Say you no know
If dem no call you
My brother no go
Make you worry sey you never blow
If your own time reach
You sef you go blow
Money no reach to buy spaghetti
You fit buy the abacha
Money no reach to order the Uber
You fit climb the okada
No dey look another man dey laugh am
Nobody knows tomorrow
Make you try to dey help your neighbour
So himself no go borrow?
What is it just stop to dey worry
Wahala no dey finish
Even if you get the money baje
Wahala no dey finish
See this life e no balance
So wahala no fit finish
If you get you no get
E no mean my brother
Wahala o kin tan
Just dey Jaye dey thank God.
I just want to Live my life and go (Cos wahala no dey finish)
If you get you no get
E no mean my brother
Just dey jaye dey thank God (Wahala no dey finish)
Said I just want to Live my life and Go (wahala no dey finish)
If you get you no get ee no mean my brother just dey Jaye dey thank God.
Wahala no de finish