Omo
For the place wey dem born me, water no dey flow
NEPA light na for kings, meehhnn
No be beans mehhnn
If you manage, you go get light
But em no go full, you go still pay for the bills, meehhnn.. (Bills Meehhnn)
Poverty go take you to your kneels meehhnn
No be only motor wey dey kills meehhnn
Get many people wey no get light, sweat for their heels meehhnn
You go know say them no get chills, meehhnn
But we get hope
If we fall small, we go stand up.. (Common.. Stand Up From There)
Ain't no giving up oo.. Only popo fit to make us hand up
And even with a man down, we go still dey man up.. (Man Down.. Man Up) (Hhmm)
And you can't beef.. (Hhmmm)
Cut una like suya.. No delay
Nobody go fit relate.. (Wo)
Una never dey mean to fight back, because all of una just dey play.. (Play)
Leave peace talk.. I dey gee'd up
Because many get hands but them no fit work
Get many things wey me eyes don lock up for this world wey me self I no fit talk
For this life rough
If you get money to chop today, make you no rejoice oo
Just because oo.. (Aagghh)
You fit chop today, make tomorrow chop you
First Off.. (Real Talk)
My people dey here wey dey hunger
Them no get strength to dey talk.. They don quiet.. (Quiet)
The money wey belong to the masses e don follow politician go house.. E dey praivet.. (Private)
My people dey suffer.. And food no dey
Na who balance dey chop diet
Money no dey, you wan try flex
Hope dey.. Why Stress
Balanced diet na for you wey never die yet.. (Hhmmm)
Your leaders wey be monster
Country e be like weapon wey them fashion against man.. Na to sell am, use the money prosper
If life na bitch.. Them be pornstar.. (Oohh Wooww)
And if you wanna talk about the many many story wey dey happen for the location we gather we dey see wey we mah no fit talk
Omo.. Brain fit burst
Leave peace talk.. War for the whole street boys
Cause
Leave peace talk.. I dey gee'd up
Because many get hands but them no fit work
Get many things wey me eyes don lock up for this world wey me self I no fit talk
For this life rough
If you get money to chop today, make you no rejoice oo
Just because oo.. (Aagghh)
You fit chop today, make tomorrow chop you
(I No Send Them Taallkk)
Bring your Ps them.. (Real Taallkk)
Make we fix them.. (Real Taallkk)
You see your children.. (Real Taallkk)
We go teach them.. (Real Taallkk)
Your wages and pension.. (Real Taallkk)
We go increase them.. (Hmmm)
All you ghatz do na to vote us back into the system