I no Dey use my peace play with nobody
E dey be like joke till I nod one person
Wetin no funny no fit be comedy
If me and you no mix na cos oil and water no soluble
No go think say you be water
Only him no get enemy
Only him dey with everybody,
No go think say you be water
Nobody fit replace water
You no fit please everybody
No go think say you be water water
If you like buy a spectacle
Observe all duly protocol
Me I do my best then I kpolongo
If you get money Ejiko lolo
If you like fight like Spartacus
You go die but life go move on
Me I do my best then I kpolongo
If you get money Eji ko lolo
I no Dey use my peace play with nobody
E Dey be like joke till I Nod one person
Wetin no funny no fit be comedy
If me and you no mix na cos oil n water no soluble
Dey wonder how I take dey go
How water penetrate coconut
Me and you no align na comot
Make e no come cause see finish e ohh
Light my J before dem smoke am finish
Top my kporoko with double 3
If e pass me I go call my clique
Like e mushroom me I no Dey gree ahan
I no go fit please everybody
I no go fit do pass my ability
I no come to replace water, Ojikolo lo oh
Nobody fit replace water
You no fit please everybody
No go think say you be water,water
If you like buy a spectacle
Observe all duly protocol
Me I do my best then I kpolongo
If you get money ijikpo lolo
If you like fight like Spartacus
You go die but life go move on
Me I do my best then I kpolongo
If you get money ijikpo lolo
Adlibs under chorus
Gbabe ,
No go use gbabe
No go use ballon don oxygen
Backwood is coming
Overdo no go put person for asylum
Pour me water
Make I for Dey settle down alum
I no gree I can't kill myself
If you vex you go sediment
You go rest eh eh
Ejikolo lo