Yeah yeah
Oh wo oh
Yeah yeah
So many things I done see make me cryaaaih
Many things I done hear make me askee questions whyaaaih
Why them like e to suffer person
Roadu no goodu them they arrest person
Worku no dey after university
But that no mean say make you killee person
My mama tell me make I go to pray
My papa tell me make I go to news station
Make I condemn them for their radio
But me I done tire oh
Them no want to change oh
E be like say na roommates ee
For people for yaba left tee
Na him sedan for governmentee
Han han han han
Jaga Jaga is a normal
For Nigeria.
Jaga Jaga turn to normal
Mago mago turn to normal
Han han han han
Jaga jaga is a normal
Jaga jaga is a normal
Jaga jaga turn to normal han
For my country Nigeria
E dey make me mad oh
I done dey mad again oh
Han Han Han
That one enter I go talk am again
Han Han Han
Before and after election them go travel
When them come back them bring new style of mago mago
I no know wether na oyinbo people wen dey teachee them
But wetin I know be say
Nepa no bringee lightee
Sincee when I know the country, my mama dey struggle sincee
After retirementee dem no want to pay pensionee
My papa go to farm oh
Fulani Herdsmen pursue am oh collect him machinee
Wetin I go do oh
Them put am them talk e say makee them legalize
Na them bring am oh
Them call am Ruga putu cattle over human being oh
Han han han, make dem tell me wetin dey happen
Me I done tire so I putu mouthu for song
I tell them say
Jaga Jaga is a normal
For Nigeria
Jaga Jaga turn to normal
Mago mago turn to normal
Han han han han
Jaga jaga is a normal
Jaga jaga is a normal
Jaga jaga turn to normal han
For my country Nigeria
I putu mouth for song, yeye rolling, gaga gugu gaga
Yeye rolling gaga gaga gugu gaga
Yeye rolling gaga guru guru gaga