No time, If I start to tell u where I waka go
For d hustle, I dey chase paper like ole barawo
I've seen d rise, I've seen d fall
Seen d high & low
I've seen d comments, heard critics, taken all d throlls
Lord u say prayer is d key
I dey toil all day but d pain is what I reap
It's a blessing in disguise but omo dis blessing no fine
No come preach for here bro
That blessing I no fit wife
There's fire in d tongue, so I'm careful of whatever I say tho
Know say dem no phyno I get angels for my gate o
No mind dem, their hands no fit shake me
Even If dem get prongs dem still no fit rake me
Aye le no b small thing
In everything we do omo na sorting
Olopa tin gba sorting u b yahoo boy oya find me small thing eh
No gehfriend for a broke nigga
No FM for a broke singer ye
Ayele aye le le ayele
Woss see b like I go turn criminal
Shade wey b Dey crush me no dey want see me now
Payday dey form John Cena ace u can't see me now
"Stay legit my son" how I wan take listen na
Read up on all the richest men wey dey for naija
Either na money give dem money or them robby naija
Richest woman for Africa na abacha give am well
Oil well for that matter no b say e wish am well
For what's money without happiness
Or hard times without d people u love
I'm not sure what's about to happen next
I ask for strength from d lord up above
Cuz I'm losing my mind